32 year old Halima Sani (no be her real name) dey suffer from sexual differentiation disorder wey make her get both male and female private parts.
According to her, dis condition dey affect her life wella as she no dey fit relate normal with oda pipo.
“For my area dem dey gossip say I no wan marry not knowing my problem, na only my family know wetin dey happun.”
“E get man wey come as I tell am my problem e no gree come back again.”
She bin dey on di waiting list for operation for Aminu Kano Hospital but unfortunately di money wey former first lady Mrs Aisha Buhari release for di operations finish bifor her turn.
Dr Aminu Mohammed wey be one of di surgeons wey dey handle di operations for Aminu Kano hospital tok say Halima go fit live normal life afta her surgery.
“I don do over 130 of dis kain operations since 2006 and di pipo dey live normal lives after.”
“Dis disorder na from wen di sperm of man and egg of woman no jam in di right order after intercourse.”
Di 32 year old dey beg goment or pipo wey get money to come to her aid so dat she go fit live life like normal pesin.
“For now most of the time I dey stay for my room because I no like to dey mingle with pipo.”
Jump in the discussion.
No email address required.
Be the first to comment!
This comment section is a ghost town... Sign in